SOME CAUSES LEADING TO THE DEATH OF SOME GOSPEL PREACHERS IN 2021_ Bbc Pidgin

 



PROPHET TB JOSHUA



Synagogue Church of All Nations [SCOAN] confam Prophet TB Joshua death on 6 June, 2021 for via dia official social media page.


And e happu just a week before im 58 birthday wey suppose happun for June 12.


According to di post, on Saturday 5th June 2021, Prophet TB Joshua speak during di Emmanuel TV Partners Meeting say:


"Time for everything - time to come here for prayer and time to return home afta di service."


Di statement add say, "God don take im servant Prophet TB Joshua home - as e suppose be by divine will.


Family sources say TB Joshua die afta a church programme on Saturday.


Mourners and followers don gather for Synagogue church headquarters inside Lagos to mourn.


PST STEPHEN AKINOLA



Stephen Akinola, di General Superintendent of Redemption Ministries worldwide die hours afta TB Joshua death filter in.


Reverend Akinola die in di early hours of Sunday 6 June 2021 for hospital inside Abuja, Nigeria capital.


Na one of im Pastors confam di news of im death on Sunday evening to BBC Pidgin.


"Di Church don inform all di pastors of wetin happun and dem don deposit im deadi body for mortuary."


Rev. Stephen Akinola bin dey popular for im Suya night and Wind of Fire programme.


Di Church Governing Council wey headquarters dey inside Port Harcourt, need to meet before dem go make formal announcement.


Dis na wetin BBC Pidgin find out., wey wey make dem no announce wetin happun for church service on Sunday


Di reason na because dem bin no wan interrupt di programme of di day, according to di pastor.


Tori be say di wife and son dey Abuja wia di Pentecostal preacher die.


News of Stephen Akinola death filter in hours after Prophet TB Joshua die hours earlier.


Before e die at di age of 68, e bin sick for some time and dem bin dey treat am inside one hospital for Abuja



Pastor Dare Adeboye

Son of Pastor Enoch Adeboye 



Pastor Dare Adeboye, di son of the General Overseer of the Redeemed Christian Church of God Worldwide [RCCG] die at age 42.


Statement from RCCG on Thursday, 6, May 2021, confam am say Pastor Enoch Adeboye son die on di 4th of May, 2021.


Pastor Oluwadamilare Temitayo Adeboye [Pastor Dare or Pastor Dee as many know am] shock and shake many young Christians.


Dare death wey happun in a sleep for Oron, Akwa Ibom state, throw one of Nigeria largest church congregation into murning.


Dare brother Pastor Leke Adeboye, wey also be di Special Personal Assistant to im papa, Pastor Enoch Adeboye di General Overseer of RCCG worldwide, describe how im brother take die.


E say Pass Dee fist still dey tight like say e hold mic but dis time, im eyes dey closed and e dey smile.



PASTOR IGHODALO, Pastor of Trinity House Church



Ibidunni Ituah-Ighodalo di wife of Pastor Ituah-Ighodalo of Trinity House church for Lagos, Nigeria death on Sunday 14 June, 2020.


Di death of di wife, head pastor and former Nigerian beauty queen shake Nigeria wella dat time.


Tori be say di say di madam Ighodalo, die for her hotel room for Port-Harcourt, Rivers State southern Nigeria.


She be businesswoman and marriage counsellor wey set up NGO foundation to give support to couples wey dey find pikin to born.



EVANGELIST REINHARD BONKE



Popular German Pentecostal evangelist Reinhard Bonnke die at di age of 79 for December 2019.


Im wife Annie Bonnke na im announce im death for Evangelist Bonnke verified Facebook page.


For inside di post she say "im pass away peacefully".


But Reinhard Bonnke death shock many inside Nigeria wit disbelieve say di popular preacher die.


Late Bonnke bin organize plenty rivival crusade across Nigeria wen im bin dey alive and strong.


• PASTOR ELIJAH ABINA SON


Pastor Elijah Abina, di General Overseer of Gospel Faith Mission International, lost im son, Emmanuel Folorunso.


Tori be say di son of 85-year-old Pastor Abina, wey also be founding father of di Pentecostal Fellowship of Nigeria, happun on Wednesday, April 28, 2021.


Pastor Emmanuel Folorunso Abina die at 53-years-old.


Tori of di death of di son of di di leader of di 65-year-old church shock many.



PASTOR ESSA OGORRY



Pastor Essa Ogorry death a year afta im wife die

Pastor Essa Ogorry die days afta e become popular for refusing to officiate one wedding for for Rivers state due to di lateness of di couple.


Di founding pastor of di Fulfilling-Word Foundation Church, Essa Ogorry, die 16 February 2021 after some challenges with his health.


Wetin shock many Nigerians wey sabi dis pastor na say Essa Ogorry die exactly one year after im wife, Tonyemieba death.


Mrs. Tonyemieba Essa Ogorry ' Nee Amachree [Pastor Tee as many sabi her], bin die on 16th February 2020 @ 7:50pm, according to her memorial.


Pastor Essa Ogorry die at di age of 55. While im wife Pastor Tee die at age 51.


And di couple leave behinf teenage child of 17 years old

SOURCE: BBC NEWS PIDGIN

ALSO;

• The death of Assemblies of God, Past General Supretendent 

• The death of the Daughter of Prophet Shepard Bushiri.


In all the call is not for fear but for courage.

To run the race with sincerity while it is day.. With prayer and purity the Church prevails.

Post a Comment

0 Comments